Legal Principles
19/06/2025
Why You Should Write a Will Today
Death is inevitable, but confusion over your estate doesn't have to be. A Will is a simple but powerful legal document that ensures your wishes are respected after your passing.
Without a Will, your loved ones may face delays, disputes, or costly legal battles. The law will decide who gets what and it may not be what you would have wanted.
Writing a Will:
*Protects your family and dependents
*Ensures your property goes to the right people
*Allows you to appoint guardians for your children
*Gives peace of mind while you're still alive
Don't leave your legacy to chance. Write a Will today.
Follow this page for Legal knowledge
13/04/2025
Hcrc's Position on the Supreme Court Judgment in the Case of Sunday Jackson Press Statement Hcrc's Position on the Supreme Court Judgment in the Case of Sunday Jackson On March 7, 2025, the Supreme Court of Nigeria...
You sabi say Law get two ogbonge principles?
Na the law say everybody get the right to "fair hearing", and fair hearing mean say the matter wey com before the law court, even person wey no get anything to do with the matter wey just dey observe go conclude say the court treat the party wey dey before the court with fairness. And the court no just end there but e do everything wey d Law don formulate as Legal Rules.
The koko of the matter be say nobody go fit say the court don give fair hearing if e no follow this two(2) ogbonge principles of natural justice wey the law provide: Dem call am for Latin Maxim wey include;
1. Audi Alteram Partem and
2. Nemo Judex Incasasua
No worry about how to pronounce the two principles wey dey for up. The first one wey be "Audi Alteram Partem" mean say "hear the other side". E mean say dem no fit say Dem give you fair hearing if Dem no allow or no gree give you the opportunity to hear from you make you sef defend your self first and call witness if you go like call anybody to defend you for court. Even sef God no condemn Adam for the Garden of Edem until God give am the opportunity to talk for himself so why court or anybody go come give judgement wen e never hear from you?
The second one wey be "Nemo Judex in casasua" simply mean say "make nobody be Judge in his own case". E mean say make person no decide for matter wey himself get interest in one way or the other. If the matter concern your family member, friends or anybody wey connect to you or even sef if na your own matter, the law dey talk say make you no sit-down for the matter, say make you wash your hand with soap and water from the matter so that you no go dey bias and you no go dey support anybody.
So now you know the two ogbonge pillars wey dey hold law for court and anywhere wey Dem dey take decision. If Dem no gree follow this two pillars wey we don talk about abeg you sef no gree until Dem do justice.
Click here to claim your Sponsored Listing.
Category
Website
Address
Beside Golden Tulip
Yenagoa