TAFIA WORLD

TAFIA WORLD

Share

16/05/2025

SENIOR BROS WEY WAN IMPRESS HIM BABE WITH NEW PHONE CHOP KPONSING FOR ASABA

Wahala be like Nons Miraj y@nçh this afternoon for Asaba stadium. As Team Delta dey prepare for National Sports Festival wey go take place for Ogun State, area gbab on bros wey go achieve wires.

According to reports, the bros enter stadium like who wan watch people wey dey train before person know he don enter our quiet part of the stadium with tools dey begin achieve wires.

Area hold am and show am small love. He cøñf£ss say he never do this kind thing before say na he first time and na him girlfriend wey dey pressure am for new phone make am come achieve the wires.

He say na the coppers wey dey inside the wires be he target because them dey expensive, and he nor want make he girlfriend breakup with am.

TAFIA WORLD

11/04/2025

Three Americans wey bin dey convicted for dia role for one failed coup for DR Congo last year don go back to US to complete dia jail terms.

Di three of dem bin first dey sentenced to death by military court bifor dem change am to life in prison last week.

Dis repatriation dey come as US and DR Congo dey negotiate for deal to exploit di central African kontri ogbonge mineral wealth.

Di Americans dey part of 37 pipo wey bin dey sentenced to death last September on top accuse say dem lead attack on both di presidential palace and di house of one of di ally of President Felix Tshisekedi last May.

Want your public figure to be the top-listed Public Figure in Lagos?
Click here to claim your Sponsored Listing.

Category

Culinary Team

Attire

Telephone

Address


Lagos