BBC News Pidgin

BBC News Pidgin

Share

09/06/2026

Real Madrid don announce say Alvaro Arbeloa tenure don end as di first-team coach.

For statement wey di club release on Tuesday, 9 June, dem say di club and Arbeloa don reach agreement to end im tenure.

“Real Madrid dey deeply grateful to Alvaro Arbeloa, wey throughout im career for di club, from di time e join our academy, don always demonstrate loyalty, commitment, and professionalism. Im persona na true example of di values of our club,” di club tok.

Arbeloa, wey be former Real Madrid defender and wey bin don also coach di club youth and reserve sides, bin dey appointed for January to replace compatriot Xabi Alonso and bin guide di 15-times European champions to second-place finish ⁠for LaLiga.

Who you tink say dey come onboard as di new coach?

09/06/2026

Govment tok-tok pesin Felix Kwakye Ofosu confam say di ex-CEO of di Ghana Microfinance and Small Loans Centre wey dem bin sama 10 years in prison don land for Ghana.

She bin chop sentence sake of more dan 70 corruption-related charges, wey include embezzling more dan $6M of Ghana taxpayer moni.

Full tori: https://www.bbc.com/pidgin/articles/cp3xwgk382no

Want your business to be the top-listed Media Company in Lagos?
Click here to claim your Sponsored Listing.

Address


Lagos