Xplain Am

Xplain Am

Share

02/05/2025

Wetin be GDP wey dem always dey shout?

You go just hear: “Nigeria GDP grow by 3%”, and you go dey wonder, “wetin concern me?”

GDP simply mean the total value of all the work, business and hustle wey happen for a country within a time.

If e high, dem go say economy dey grow.
If e low, dem go say economy dey slow.

But wait… no be everything GDP dey show.

Make we break am down from tomorrow. E go shock you say Nigeria GDP fit rise, but you still dey suffer.

Follow this page, make we Xplain am together.

14/04/2025

Middlemen Wahala

> Reason 3: Too many hands dey touch the food

From farm to market, how many people don touch that food?

Farmer go sell to agent.
Agent go sell to wholesaler.
Wholesaler go sell to distributor.
Distributor go sell to retailer.
Retailer go sell to you.

Each of them wan chop small gain. But small gain x 5 people? Na big wahala!

So even if the tomato na ₦100 from farm, e go turn ₦600 before e reach your kitchen.

Middlemen no be bad people, but when e too much, price go climb anyhow.

Want your school to be the top-listed School/college in Abuja?
Click here to claim your Sponsored Listing.

Category

Address


Abuja